Wia dis foto come from, RevolutionNigeria
Na 5 August, 2019 di Revolution Now group do nationwide protest wey land many pipo including di leader of di group Omoyele Sowore for police net.
One year later wey be Wednesday 5 August, 2020 di ReveolutionNow group, dey do protest for Lagos and Abuja to mark one year where di organisation do im first protest.
Di Department of State Service (DSS) bin arrest Omoyele Sowore, wey also run to be president of di kontri, on August 3rd for one hotel for Lagos where im dey stay.
Fotos from today protest
Wia dis foto come from, Tosin
Protesters wey dey carry sign boards
Wia dis foto come from, Tobi Oyetunde
Protesters for Ikeja Computer Village, Lagos
Wia dis foto come from, Tobi Oyetunde
Wia dis foto come from, Sowore
Armed security for di venue of Revolution Now for Abuja
Afta di failed 2019 protest, di goment later accuse am of terrorism, money laundering and cyberbullying of Nigeria President Muhammadu Buhari. Di case still dey court.
Supporters of di group don gather for Ikeja area of Lagos, southwest Nigeria and Abuja capital of di kontri to protest wetin dem call bad leadership or di kontri.
Sowore don earlier call im supporters to join di rally today if dem get time.
Local media dey report say 40 of di protesters chop arrest on Wednesday.
Wia dis foto come from, Tosin
Source link